Wt/pcm/oyin adejbi

< Wt‎ | pcm
Wt > pcm > oyin adejbi

Chif Oyin Adejobi(1926-2000)na one pesin wey sabi akt well well for southwest Naijá an plenti pipul know am.Im nem, "Oyin" min "Honey".E rait plenti play an e do plenti yoruba play on top stej,for Telefishon an muvi.E mari one aktres, Grace Oyin Adejobi an dem dey togeda til e dai. Na one play wey yuz tek tok of im own laif, wey e kol "Orogun Adedigba" naim mek plenti pipul know am well well. E get one play wey dem dey show evri week for Telefishon,"Kootu Ashipa"[Ashipa kort],for Naijá Telefishon Otoriti (Nigerian Television Authority)Ibadan. Na im own name Oyin Adejobi e tek kol im tiata konpini. Som of di muvi e do:Iya Olobi, Orogun Adedigba,Ile Iwosan, Kootu Ashipa,Iyekan Soja,Ekuro Oloja an Kuye.