Wt/pcm/odunlade adekola

< Wt‎ | pcm
Wt > pcm > odunlade adekola

Odunlade Adekola,(dem bon am for 31 December 1976)na one Naijá akto,pesin wey dey sing,pesin wey dey do fim,produza an darekto. Plenti pipul bigin to know am wen e akt for Ishola Durojaye 2003 fim, wey dem kol "Asiri Gomina wa".E stil don akt for plenti plenti Nollywood muvi sins dat time. Naim get stat am an na im bi di CEO for Odunlade Adekola Fim Prodoshon.(OAFP) (Odunlade Adekola Film Production)

Im Life wen E stil Smol edit

Dem bon Adekola for Abeokuta,Ogun State, an die im stil grow, bot e kom Otun Ekiti, for Ekiti State.

Im Skool Matar edit

Odunlade go St.John Pramari Skool(St John Primary School) an St.Peter'Kolej (St.Peter's College),for Abeokuta,Ogun State an e kolet West African School Certificate Examination bifor e kon go Moshood Abiola Polytechnic,(MAPOLY),na die e kolet Diploma Satifiket. Odunlade kon stil go skool for Yunifasiti of Lagos(University of Lagos) an e kolet Bachelors Degree on top Business Administration.

Im Work edit

Odunlade Adekola stat to dey akt for 1996, an na dat sem year e join di Association of Theatre Arts Practitioners.E don show well well for plenti play,e don darekt plenti fim an e don produz plenti Naijá fim dem sins di time wen im stat to dey akt. Adekola win Africa Movie Academy Award for di Best aktor for 2014.E show sey im sabi sing wen enta Naijá muzik industri for December 2015.Im foto plenti well well for intanetmeme on top Naijá weboshere. Odunlade kon bikom Brand Ambassador for RevolutionPlus Property Development Company for 17th, September, 2018.Na for di konpini offis wey dey Ikeja naim dem do di Ambassador selebreshon,dat day na spesha day for Odunlade Adekola. Naim stil bi Brand Ambassador for Goldenberg, Globacom an som oda konpini dem.

Im own Life edit

E mari Ruth Adekola for 2003, an e bon four pikin dem.

Som of di fim wey E don do edit

Ile Afoju(2003) The Vendor(2018) Alani Pamoleku(2015) Asiri Gomina Wa(2003) Mufu Olosa Oko(2013) Kabi O osi(2014) Sunday Dagboru(2010) Monday Omo Adugbo(2010)