Wt/pcm/muyiwa ademola

< Wt‎ | pcm
Wt > pcm > muyiwa ademola

Muyiwa Ademola na Naijá aktor, pesin wey dey mek fim & darektor.Im fim,"Ori" (fate),wey e do for 2005 naim win di Best Indigenous fim for di first Afrika Muvi Awod dem ( Africa Movie Awards).Dem shuz am for di 4th Afrika Muvi Academy Awards for Most indigenous Aktor.

Im Life wen E stil Smol edit

Dem bon am for 26th,January 1971 for Abeokuta,di kapita of Ogun State,for southwest of Naijá.E go St.David's High Skool,Molete for Ibadan kon kolet West Africa Secondary School Certtificate. E kon go Yunifasiti of Ibadan wie e kolet Bachelor Degree on top Adult Edukeson

Im Work edit

Charles Olumo, wey plenti pipul dey kol "Agbako",an wey dey liv for im vilej, Abeokuta, kon hep am enta Naijá fim Indusri. One darektor,wey dem dey kol S.I Ola,naim kon tich hau to akt & hau to mek muvi. E stat to dey akt for 1991.E do im first muvi wey e rait wit im own hand an wey e kol "Asise"(Blunder) for 2015. Dibel wey dey sell Jeneretor naim yuz im money tek mek di muvi.