Wt/pcm/cyril stober

< Wt‎ | pcm
Wt > pcm > cyril stober

Cyril Stober na Naijá jonalis & pesin wey dey read nius.Dem bon for Naija state.Na one skool wey dem dey kol Fatimah Sekondri Skool bifor but wey dem don dey kol Father O'Connell Science College Minna nau, naim e go.

Im Work edit

Stober work as jonalis & pesin wey dey read Niuz for wetin pass 30 years,an for all dis years,na so so 9oklok niuz for NTA Network an NTA Prime Time niuz im jus dey read. E get one kain dres wey pipul tek know am well well, e go wie nativ dres, wie kap an eye glas dem.One rumor hapun for 2015 sey Stober don ritaya komot for work,pipul kom dey surpriz sey dem stil see am again on top Televishon wey e dey read niuz. Stober ritaya komot for Nigeria Broadcasting Authority 1st of April,2019. Cyril Stober stil do som work for NTA Network propram dem even after e don ritaya

Im Own Life edit

Stober mari Efun Merriman-Johnson,one of di pipul wey dem dey read niuz togeda bifor bifor,but wey don ritaya komot for Nigerian Television Authority but dem leta divors. Stober mari Elizabeth Banu for 13th of January 2019,